My people, I hope say una dey okay. I don come again with another story when Una go learn from. You fit even laugh but the important thing be say make you put your head down.
E get one time, for okere that year, one werey dey weh dem dey call big bug. Big bug na master of wagala and people sabinak for him yeye lifestyle. He get one person weh just dey plan am for back and I dey suspect say na you.
Big bug get only one thing when dey make am fear, hin name na antibiotics. When hin don too do him self go come collect a quick dose of meds which dey make him body calm down. But, as time don dey pass, Big bug come wise for street.
He don get odeshi so the antibiotics nor come dey work, na so wahala don start o and na you cause am.
You go use antibiotics incorrectly or overuse them, and you think say consequences nor go dey, see the way you don hand yourself as meat to slaughter, Big Bug come realize say you self nor reach.
Normally, I go still drop solution for you na. You nor suppose fear.
- Nor dey skip doses, don’t take more than prescribed, and don’t stop taking them just because you don dey feel better. You suppose finish wetin you don start.Â
- Â You go reject the temptation to play doctor. Only take antibiotics when doctor don tell you.
- Nor dey use medicine do brothers keeper, na your thing use am.
- Try dey wash your hands, cover your mouth when as you dey cough, and avoid close contact with people who don sick.
The Consequences of Drug Resistance
You not go like the result when Big Bug not dey fear antibiotics again o.
- Superbugs: As Big Bug become resistant, he fit turn into superbug – a bacteria when fit kpai you.
- Prolonged illnesses: As the resistance nor dey, e fit lead to prolonged illnesses, which can be costly, painful, and even life-threatening.
- Increased healthcare costs: The economic nor det smile, so why you go come dey waste money like that?Â
You get the power to defeat Big Bug but na your choice to make last last. Remember, na you the thing to later sweet. Stay healthy, stay happy, and stay jiggy!